Home As e de hot Bauchi Govt don register sickle cell patients for free Healthcare

Bauchi Govt don register sickle cell patients for free Healthcare

242
0

Di Bauchi State Government don register 200 people wey get Sickle cell for di vulnerable programme component inside di Bauchi State Health Contributory Management Agency.

Di Executive Secretary for di agency, Dr. Mansur Dada, been yan say di patients been dey registered for di Abubakar Tafawa Balewa Teaching Hospital and dis one go help dem get access to free medical services wey federal government dey give under di Basic Health Care Provision, BHCPF programme scheme.

He also yan say di people wey dem don select go fit get access to primary and secondary Healthcare by October 1st after dem don do meeting with management of ATBUTH.

Dada still add say di government go pay N500.00 for each patient monthly and di agency don register 100 people from the informal sector for di state.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.