Home As e de hot Back pain fit be symptom for TB! – Consultant

Back pain fit be symptom for TB! – Consultant

210
0

Consultant neurosurgeon for di Federal Medical Center Abuja, Dr. Douglas Okor don warn make naija people wey dey get back pain stop to dey ignore am because e fit be sign for Tuberculosis as no be everytime e dey come with cough, e fit still carry back pain come.

Di neurosurgeon yan say if dem no check and treat spinal TB, e go cause serious damage to di spine wey go need surgery.

He tok say TB and infection from bacteria na di 2 common infection wey dey affect di spine.

Dr. Okor still add say TB dey very common for dis side and things like HIV, reduced immunity, etc., fit expose person to am.

Back pain na di most common symptom for spinal Tuberculosis as National Library of Medicine tok. Di intensity no dey last because e dey go from constant mild, dull aching, to severely disabling and na mostly for thoracic region e dey heavy.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.