Home As e de hot Baby girls fit comot breastmilk or discharge. E dey normal – Expert

Baby girls fit comot breastmilk or discharge. E dey normal – Expert

241
0

Gynaecologists don beg make new mama dem no dey worry if dia new born girl pikin start to dey comot some vaginal discharge for di first few days after dem born am.

Dem tok say e no dey happen to every girl pikin but e dey normal and e no dey cause any wahala.

Di experts even reveal say she fit also comot small breast milk for di first few days and dem dey call am neonatal or witch’s milk.

Di experts continue say e dey happen for di first 10 days but if e continue pass, then make dem carry di pikin go hospital to see doctor and as lo if she comot blood instead make dem go see doctor.

Di experts, Consultant Gynaecologist, Stanley Egbogu point out say discharge no dey comot for boy pikin because dem get low estrogen.

Egbogu wey be maternal care expert for di Nnamdi Azikiwe Teaching Hospital, Nnewi reveal say di discharge na because of di exposure wey di baby get for di womb of di mama and also make dem no dey press hot water for baby chest because e fit make di lactation continue.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.