Home As e de hot Babcock don do 959 heart surgery – VC

Babcock don do 959 heart surgery – VC

154
0

Oga Vice-Chancellor for Babcock University inside Ilishan Remo, Prof Ademola Tayo don yan say Babcock University Teaching Hospital don do more than 959 open-heart surgeries for di last six years.

Tayo wey reveal dis one on Wednesday for di Founder’s Day press conference inside di University say out of di more dan 959 open-heart surgeries wey dem don do, more than 518 na major surgeries with like 95 percent success rate and di hospital dey also give their students wey dey study medicine, nursing science, and public health chance to use equipment come have one one one with specialists as many other universities no dey do.

He add say di celebration wey dem do na also 63rd founder’s day anniversary for di Adventist Seminary as Babcock na di second private university for naija wey get license to do open distance education.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.