Female reproductive expert wey be Dr. Amuche Okafor don reveal say women wey get belle wey dey take antibiotics wey doctor no confam dey danger brain or dia pikin wey dey belle.
Nwafor wey be Senior Registrar for Obstetrics and Gynaecology for di Alex Ekwueme University Teaching Hospital, Abakaliki, Ebonyi State yan say experts dey always warn make women wey get belle no dey take antibiotics because no be all of dem dey okay and e dey risky for women wey get belle come get urinary tract infection to treat am for house with any antibiotics wey doctor no confam.
Di gynaecologist still add say e dey cheaper and more safe for women wey get belle to go hospital when dem get any sickness because e fit dey dangerous for dem to dey visit chemist shop.
Nwafor still note say because antibiotics fit cause miscarriage, doctors dey only confam am very situation dey critical.
Di expert come advise make women dey register for antenatal on time so dem go fit dey take día health matter to di right doctor.
.
(Punch Healthwise)