The Permanent Secretary, Delta State Primary Health Care Development Agency, Dr. Jude Winful-Orieke don reveal say more than 65,000 young women don get contraceptives for Delta in 6 months and he tok dis one for Asaba on Monday for event wey dem do to mark 2022 World Contraception Day.
Di WHO been keep September 26 every year for di world to mark World Contraception Day so e go help improve awareness wey people get for contraceptive methods wey dey and also make young people fit make good decision for dia sexual and Reproductive health.
Dr. Winful-Orieke yan say di na United Nations Population Fund (UNFPA) for 2007 been keep di Day, then governments for plenty nations, even naija come cop am as yearly event.
He point say if contraceptives dey available, unwanted pregnancy go reduce and even HIV and AIDS plus other sexually transmitted infection and disease for young women.
He yan say dem dey focus di 2022 Day to improve awareness say contraceptive dey very impotankpa for people wey don reach to born.
The permanent secretary Winful-Orieke been send him represent wey be Director, Community Health Services, Dr. Paul Yinkore for di event.
.
(NAN)