Di Government wey dey govern Zamfara State don give order make dem convert the Samba COVID-19 Centre wey dey Gusau to General Hospital.
The Deputy Governor, Sen. Hassan Nasiha, na him give this order as him visit the Centre on Tuesday. He talk say this order na the way government dey try make sure say their state people dey get better service from management and staff. He come add say as people don dey increase for their state, the new hospital go helep di people get better and easy Healthcare.
The deputy governor also tell Ministry for Works to sharperly give key to Ministry for Health make dem begin work. He come still give Ministry for Health 2 weeks to make sure say the Centre don turn to Government Hospital.