Home As e de hot We don vex – Abia State NMA

We don vex – Abia State NMA

265
0

Di Abia branch of di Nigerian Medical Association don vex say dem go hunt down di quack doctors and dia offices wey dey dia state.

Di state Chairmo for NMA, Dr. Isaiah Abali tok say di new officials wey dem get go use all día power plus di law to fight all quack wey dey di state because na very serious problem dem be for people wey dey practice true medicine especially for big state like Abia.

Abali tok say dem go fight dis quack because no be only medical people dem dey affect but even di state people wey just wan good health care, and dem go make sure to use di law to kolobi all di people wey dey work for di quack places.

He come still promise say him office go make sure say dem get one on one tok with state government so govt go fit pay di salaries wey dem owe dia members, as govt dey owe workers for Abia State University Teaching Hospital (ABSUTH), Aba, 21 months and the Health Management Board 11 months.

Di Chairmo still come praise Dr. Chimezie Okwuonu wey hand am baton plus him team say dem do well adn hi go make sure say him do better for dia members.

Abali be Consultant Orthopedic Surgeon for the ABSUTH, Aba.

.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.