Di Presido, Major General Muhammadu Buhari (retd.), on Thursday don guarantee German-based mRNA vaccine manufacturer, BioNTech, say Naija dey ready to collabo with am to produce vaccines.
Buhari also tok say he dey wait make di company commit so dem go fit reach di goal naija get for research, development, and manufacturing.
According to statement wey Presido Special Adviser on Media and Publicity, Femi Adesina sign, Buhari tok dis one when he meet with Oga Executive Chairman of KENUP Foundation and represent of the CEO of BioNTech, the mRNA vaccine patent holder, inside Africa, Mr. Holm Keller, for di State House inside Abuja.
Buhari tok say him dey invest well for health, education, research and development for him tenure and him dey give go ahead for discovery and collabo just like dis one with di private pharmaceutical company wey go begin routine vaccine manufacturing for di country.
Buhari come tok say covid19 with all him palava don make naija and plenty middle-income countries to realise say e dey very necessary to get manufacturing capacity expecially for di health sector.
Presido also tok say plenty opportunity dey dis country so make di Foundation and other people wey wan invest pay special attention to our country wey get population pass any other African country.
Minister of Health, Dr. Osagie Ehanire, come add say Buhari get serious passion for public health security and na why him dey receive dis team with open arms and dem dey open to collabo to produce new vaccines.
Keller come tok say him company na public-benefit foundation wey dey dedicated to vaccine equity wey dem go do through manufacturing schemes wey dey good for di country.
He tok say dem dey work on vaccines for malaria, tuberculosis, HIV, monkeypox, and others wey dem go produce for Africa and dem dey find very good treatment for cancer inside Africa, wey for now just dey available for the richest people for some parts of di world.