No he small vexation Naija people on twitter dey show as TrackaNG posted di photos from Dapa community in Kwali Area Council of Abuja wey small pikins dey fetch dirty water. According by di post, na only during rainy season over 1200 people wey dey live for Dapa dey see water at all.
Some people even dey ask “who be FCT minister again?”