Home As e de hot US Government don visit NCDC! See Why!

US Government don visit NCDC! See Why!

221
0

Di United States Government don send represent to naija through their Centre for Disease Control and Prevention to come learn how to do capacity building for global health security, disease detection, preparedness, and response.

Di Oga Director of Global Health Advocacy, United Nations Foundation, Mr. Brian Massa, wey be di person wey carry di represent dem come di National Reference Laboratory of the Nigeria Centre for Disease Control inside Abuja tok say di represent dem come make dem learn for naija.

Massa tok say di represent dem dey watch how things be for our lab, how strong health facilities dey impotankpa and why e good to record and share data of disease wey dey affect di country like Monkeypox.

Him tok say dis partnership wey dey between naija and US dey very good and because of wetin dem dey learn for here, the US CDC don dey dey better.

Di Director-General, NCDC, Dr. Ifedayo Adetifa, also tok say di NCDC’s NRL wey dey Abuja na di focus of the organisation as e dey provide High-Quality Public Health Laboratory Services, come dey coordinate laboratory-based surveillance and e dey provide oversight to di other lab for public health wey dey di country.

Adetifa come tok say di US Government through the USCDC and dia partners don support di agency with laboratory equipment, things we people fit chop or use (consumables), reagents and technical support.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.