Tori wey dey reach us from Ebonyi State na say di government dey vex seriously with United Nations Population Fund (UNFPA) and organisations wey dem use build “safe spaces” for di State. Dis na because di “safe spaces” dem build for di state no try at all at all.
Sources wey no wan make we publish dem name talk say di Commissioner for Women Affairs, Mrs Chinwe Okah bin vex wella for Ebonyi Women Initiative for Acceleration (EBOWIFA) wey bin handle contract for di safe spaces dem build for di state. Safe spaces na place wey young people fit go to seek advice on adolescent health services. Our tori pesin wey go Okposi Safe Space inside Government Secondary School Okposi talk say members of di community dey squeeze face. See photo of di place:
Compare am with di Safe Spaces same UNFPA built inside Cross River State.
Ogbonge public health doctor, Dr. Laz Eze wey go di Okposi Safe Space squeeze face talk say na terrible job dem do there.