Di people of Amangbala Community in Afikpo North LGA of Ebonyi State dey cry out to di local government, State government, NGOs and people wey get money make dem help them finish their health centre project. Na inside Talkhealth9ja Radio Show for Unity FM Abakaliki dem talk dis one o. Chairman of di Amangbala Health Committee, Engr. Francis Onuh talk say their current health centre building no good at all at all as some part don fall sef and di Community dey try relocate am to their new townhall building. He said dem don spend over N7 million recently and go need more than N10 million to finish am.
Di Vice Chairmo and Secretary of the Amangbala Development Union wey talk for the radio show also stressed the need make new LGA Chairman and politicians take health more seriously. Callers for di show say almost all di primary health centres in Ebonyi State no good at all at all. You fit click on dis link make you watch am on Facebook.