Home As e de hot Run from Skinlite South Korea Face mask! – NAFDAC

Run from Skinlite South Korea Face mask! – NAFDAC

190
0

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control don warn naija people make dem no dey use one face mask wey Skinlite for South Korea produce wey dem dey call ‘Hyaluronic acid X3 face mask’ because dem don ban am.

NAFDAC tok say dem get informate from di European Rapid Alert System say di product no dey good. NAFDAC been post dis warning with No. 0036/2022 wey di Director-General, Prof. Moji Adeyeye sign, for dia official website.

According to wetin di warning tok, di product get something inside wey go affect di health of pikin wey dem never born, di reproductive system and e fit cause skin réaction too.

Di NAFDAC DG come order importers and people wey dey distribute and even sell to naija people make dem stop to dey bring in di product or eveb sell am to people.

Di Director-General come warn naija people wey don already buy am to stop to dey sell or use but make dem carry am to di NAFDAC office wey dey very close to dem.

NAFDAC come beg make people wey dey work for health, patients and all naija people to report any issue wey concern dis product to NAFDAC office wey dey close to dem or contact NAFDAC PRASCOR (20543 TOLLS FREE from all networks) or via pharmacovigilance@nafdac.gov.ng or via the NAFDAC ADR e-Reporting platform available at www.nafdac.gov.ng.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.