Di Federal Government don introduce Rotavirus Vaccine make e dey inside normal immunisation so e go protect pikin dem against Rotavirus.
Di Federal Government tok say di vaccine go helep stop more than 110,000 deaths wey dey happen for pikin dem wey never reach 5 years.
Rotavirus na the main thing wey dey cause very serious dehydrating diarrhoea for children wey dey less than 5 years.
Rotaviruses, according to wetin World Health Organisation tok,na double-stranded RNA virus of the genus Reoviridae.
Di Minister of Health, Dr. Osagie Ehanire wey tok on Monday for Abuja when dem dey do operation carry go for the vaccine, tok say to make pikin dem health better for we country na di number 1 thing government keep for heart.
Another person wey tok for the programme na di Executive Director of the National Primary Health Care Development Agency, Dr. Faisal Shuaib wey tok say Rotavirus dey cause serious diarrheal disease and e dey cause over 40 percent of diarrhoea for pikin dem.
Dr. Shuaib still come tok say dis vaccine wey dem wan add to normal immunisation dey very good because plenty children go dey saved and e go even help our economy.