Prof. Emmanuel Ameh wey dey di department of Peadiatrics Surgery, National Hospital, Abuja, don advise federal and state governments make dem bring out more money put to make better surgical treatment and care for di country.
Ameh tok dis one for di event for training for journalist wey di NGO, Smile Train organise inside Abuja.
The expert tok say e dey pain am say plenty people dey kpai because of complication wey follow surgery and government dey put eye more on top treating infectious diseases more than other health mata.
He come still advise government make dem open up surgical care so e go cover 75 per cent of the population and 50 per cent of children wey never reach 15 years. And make National Health Insurance Scheme (NHIS) comot limitation wey dey for treatment of surgical conditions.
Ameh still call government make dem train more experts wey go dey provide surgical care especially for di area of support.
.
(NAN)