Our Presido, Muhammadu Buhari, don give go ahead to build 3 orthopaedic hospitals for we country.

The minister wey dey in charge of health, Dr Osagie Ehanire talk this one when dem do the opening for the Primary Health Care Leadership Challenge wey Nigeria Governors’ Forum organise for the State House Abuja on Wednesday.
Dr. Osagie talk say North-East get one, North-Central get one and South-South get one. The states be Benin, Jos and Jalingo.

The oga wey dey direct the Bill and Melinda Gates Foundation for the country, Jeremie Zoungrana, talk say the Primary Health Care (PHC) Challenge fund don give dem the chance to see people wey dey lead well for healthcare and also dem go fit support the Nigeria Governors’ Forum (NGF) as dem dey support the PHC areas for their states.

Another person wey talk her mind for the event na the Minister for Finance, Zainab Ahmed and she talk say money wey Federal Government don give states as loan wey dem no go pay back na N471.9 Billion and dis dey under the 1.5 Billion dollar assist wey World Bank give countries wey dem call States Fiscal Transparency Accountability and Sustainability (SFTAS) Programme.
She talk say she happy say as all the 36 states don get their own share of the loan wey dem no go pay back, dem don also start the change wey dem suppose for their financial system.

Di NGF Chairmo, Governor Kayode Fayemi, come talk say di event na to show say as governors dem dey ready build ogbonge Primary Health Care System and e go help dem comot every wahala wey dey drag our public health care system.