Burjeel Medical Centre, wey be ogbonge hospital wey sabi research and treat plenty serious health palava wey dey United Arab Emirates, don talk say e dey ready to collabo with Nigerian hospitals make dem update our Healthcare system.
The oga kpata kpata of the hospital, Dr Sadir Alrawi, been talk him mind for the Annual Scirntific Conference and All Fellows’ Conference wey dem just conclude for Lagos. Him talk say dem dey come Naija to helep efforts wey the practitioners for here don dey make, say dem go come with ogbonge experience for comprehensive cancer services, diagnostics, surgery, chemotherapy, radiotherapy plus palliative care.
Him come add say dey wan bring to naija that kind treatment wey the people dey travel go find.