Di Kano State Government don talk say e go collabo with di UN Children’s Fund (UNICEF) make dem stop people wey dey shit for outside.
Na di Permanent Secretary, Ministry wey dey see for Local Government and Chieftaincy Affairs, Alhaji Ibrahim Ahmad-Sagagi, talk dis one when dem dey give carry go to share hand sanitisers to oga dem for local government wey dey chair the Water, Sanitation and Hygiene (WASH) for Kano on Thursday.
As Ahmad-Sagagi no fit make am, him represent wey be oga Director, WASH Department, Alhaji Yahaya Nuhu, come talk say their government dey open to pursue and stop all those people wey dey comot shit for outside because e dey cause palava for other people.
Him come beg all the ogas wey dey see to WASH for all the 44 local governments make dem make sure say everybofy dey in line with this matter.
Another person wey still talk for the event wey be the Kano State Represent of UNICEF, Mrs. Stella Terve, beg make naija people dem collabo make our country no get this yama yama for outside.
Terve talk say e no dey good make eye dey see shit anyhow outside especially for all those villages wey no too get toilet and no be only eye e dey do somehow, e dey also cause serious diseases wey dey infect people anyhow like cholera and diarrhoea.
(NAN)