Di Niger State Government don collabo with di National Malaria Elimination Programme make dem begin dey share 3.8 million mosquito net wey dem don treat as dem dey start wetin dem call di 2022 Insecticide Treated Nets mass distribution campaign.
Hope Obokoh, wey be di Demand Creation Officer of the NMEP, been talk on Wednesday say dem go share the net house to house make every house wey dey di 275 wards for di 25 local governments for the di state fit collect.
Obokoh also talk say both house registration and sharing for the net go start from September 1 reach September 12, 2022.
She still come add say the state government go kolobi di people wey been dey sell di free nets for the state.