Di people wey dey di Nigeria Governors’ Forum, don swear say dem go put more money and mind for primary health care for their state through wetin dem call “efficient budgeting aligned to annual operational plans”, for State House Abuja on Wednesday.
Dem come also swear say every money we dem suppose use for primary health care and all the things wey consine am, dem go release am quick quick.
Di Chairmo for the Forum, Governor Kayode Fayemi wey dey govern Ekiti State also talk say dem go make sure say dem gather people wey get experience come sabi work for the PHC as long as say dem meet the level wey each state need.
Him come also add say dem go make sure to include all the state and local government Ogas inside the Primary Health Care Challenge make every hand dey on top dis deck so things go dey go wororom.
Di other governors wey been also come the event nah Babagana Zulum wey dey govern Borno, Bala Mohammed wey dey govern Bauchi, Godwin Obaseki wey dey govern Edo, Inuwa Yahaya wey dey govern Gombe, Abubakar Badaru wey dey govern Jigawa, Simon Lalong wey dey govern Plateau, Dapo Abiodun wey dey govern Ogun, Babajide Sanwo-Olu wey dey govern Lagos, Rotimi Akeredolu wey dey govern Ondo, AbdulRahman AbdulRazaq wey dey govern Kwara, Hope Uzodinma wey dey govern Imo, Aminu Tambuwal wey dey govern Sokoto, Dave Umahi wey dey govern Ebonyi and Gboyega Oyetola wey dey govern Osun.
No be only Governors come, even some Deputies like Deputy Governors of Kogi, Edward Onoja, Adebayo Lawal of Oyo, Moses Ekpo of Akwa Ibom, Cecilia Ezeilo of Enugu, and Lawrence Ewhrudjakpo of Bayelsa also dey di meeting.