Di body wey dey regulate drug for EU tok on Friday say e don confam new way wey dem go dey use dey put Monkeypox injections so plenty people, up to 5 times more, go fit get di injection as the vaccine no too dey.
Di European Medicines Agency tok say dem fit dey give di Imvanex jab just under the top layer of the skin instead of di way dem dey put am before wey be fully below the skin.
Dis new way just dey use one-fifth of di vaccine but e still dey give di same antibodies, even though as di Amsterdam-based watchdog tok am, e fit cause skin irritation.
Madam Commissioner for EU, Stella Kyriakides tok say dis decision dey very impotankpa as dem go fit give more people vaccine with the small one dem get and also e go make vaccination easy to get for citizens wey dey at risk and people wey dey work for health.
.
(AFP)