Home As e de hot NDLEA don kolobi bobo wey dey sell contraband for Abuja

NDLEA don kolobi bobo wey dey sell contraband for Abuja

187
0

Officers wey dey work for di National Drug Law Enforcement Agency don carry di Oga kpata kpata of Marvelrock Pharmaceuticals and Stores Limited, Mr. Celestine Orakwe, for custody say him dey sell contraband medicine wey for one online market wey dem dey call Jiji.

Orakwe wey study Business Administration come graduate from University of Abuja been use certificate register the company for December 2014 and e get pharmacist wey help am but e comot from the business for 2017.

But even as the pharmacist been comot, Orakwe been continue the business and register am for Jiji in 2019.

Femi Babafemi

Talk talk person for NDLEA wey be Femi Babafemi talk say them notice am when e start to dey post di drugs for the online market for October 2021.

The statement wey Babafemi drop for with plenty grammer dey here:

“Between October 26, 2021, and August 8, 2022, the NDLEA team assigned to investigate Orakwe’s drug business activities was able to establish that he was selling tramadol 225mg and other illicit and/or controlled drugs through the e-commerce platform. He was arrested with some quantities of tramadol and Swiphnol brand of rohypnol on Monday, August 8, at a drink joint in the Jabi area of Abuja, where he had gone to make some supplies of orders made through his online channel on jiji.ng.”

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.