Reports wey dey come from di main people wey dey produce beer for naija don show say kontri people don shak beer wey reach N599.11 billion for just inside six months, from January to June 2022.
Champion Brew been end dia first half for di year 2022 as di beer company wey do better than others as Nigerian Breweries and Guinness Nigeria been lose market share.
Prime Business Africa wey do industry torchlighting for di first half for di year been gather say Nigerian Breweries, Guinness Nigeria, International Breweries and Champion Brew been combine make N599.11 billion and e been grow by 31.2 percent because by dis time for 2021 na N456.44 billion dem been make.
Even di net profit wey be dia main profit gan gan been increase 54.1 percent wey be from N23.44 billion wey dey profit for first half 2021 to N36.14 billion for di first half 2022.