Home As e de hot Naija fit produce ogbonge vaccines – NAFDAC

Naija fit produce ogbonge vaccines – NAFDAC

287
0

The National Agency for Food and Drug Administration and Control don tok say any vaccine wey dem produce for naija even di ones for covid19, go be international standard.

Resident Media Consultant for NAFDAC Sayo Akintola been tok say na di Director-General of NAFDAC, Mojisola Adeyeye, tok dis one when she go visit covid19 lab projects wey House of Representatives Committee on COVID 19 get for Lagos.

Adeyeye come tok say dem been no put eye enough for health till dis present government come answer to with di COVID-19 committees wey dey National Assembly.

Di Chairmo for House Committee on COVID-19, Haruna Mshelia come tok say NAFDAC DG and her management team do well because dem use latest technology come upgrade di agency to wey pass any other one for Africa.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.