Even tho say Naija been collect di wild polio-free certification, di country still dey fight di vaccine-derived poliovirus Type 2 wey just dey circulate everywhere.
Di last case of wild poliovirus wey di country been record na for Borno State for August 2016 and na for August 25, 2020 dem come certify naija wild polio-free.
Even tho experts been tok say di cases of cVDPV2 for di country no be threat, dey tok say dem suppose make sure say dem monitor and increase immunisation for di country.
Report wey Global Polio Eradication Initiative been drop show say, naija get 33 cases of VDPV2.
GPEI na public-private partnership wey national governments dey lead with six partners wey be World Health Organisation, Rotary International, the US Centres for Disease Control and Prevention, the United Nations Children’s Fund, the Bill and Melinda Gates Foundation and Gavi, the Vaccine Alliance.
Naija been record 415 cases of cVDPV2 for inside 2021.
cVDPV get 3 types wey be types 1, 2, and 3 and na type 2 dey cause most of di case wey dey now.
cVDPV na virus wey no dey common but e dey circulate sharperly and na virus wey change from di virus wey don dey weak for inside oral polio vaccine and e dey only come out for people wey no get immunisation.
Di Minister for Health, Dr. Osagie Ehanire for him own side tok say di National Primary Health Care Agency don get order and guide to make sure say dem get way to deal with di virus with di structure wey dem get to solve other health mata like covid-19 vaccination wey still dey go on for di country.