Home As e de hot NAFDAC don burst factories wey dey produce Herbal Mixtures.

NAFDAC don burst factories wey dey produce Herbal Mixtures.

200
0

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control don catch people wey dey produce one herbal drink wey dey high people wey dem dey call ‘Kurkura’

Dis one na because reports don dey come say people wey dey South West and North dey take dis ‘Kurkura’ anyhow.

Madam Director-general for NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye tok dis one when she dey tok to press people for inside Abuja for Friday and she tok say dia investigate show say di drink get plenty tobacco and cannabis.

According to wetin she tok, other herbal things wey people dey produce dem find out na “Five Minutes Power Herbs Medicine, Haonu Laha Herbal Mixture, Gamzaki Tradomedical Herbal Ventures, Barakallahu Multipurpose Herbal Mixture, and Sabon Karfi Herbal Mixture.”

She tok say even tho Haonu Laha Herbal Mixture dey registered, dem dey add ingredients wey dem no approve wey no dey good for body inside.

As the operation dey go on, dem don find one of the factories wey dey produce dis mixtures and dem don close am down come arrest di oga for there.

Dem tok say dem find out say di factory dey use Hyergra 200(Sildenafil Citrate tablet), Amafranil tablets (Clomipramine tablet 25mg), and Cannon Extra (Paracetamol 500mg+Caffeine 30mg) for día production. Di Oga of the factory gree say e dey dissolve Hyergra 200, Cannon Extra, and the Amafranil for inside drum come mix the content with boiled Kanafari, Garlic, Dundu, Marke, Hankufa, Sweetener, and Sodium Benzoate so him go fit make di Man Power preparation. But for their label, dem write ‘100 percent herbal’.

Dem been arrest di people wey dey make these mixtures but dem don bail dem as dem still dey investigate.

Di NAFDAC DG come swear say di agency go continue to burst other illegal factories wey dey make these mixtures and make sure say dem face di law.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.