Texas for inside United States don confam say one person wey get Monkeypox don die tho dem still dey investigate to know how Monkeypox take link to di death.
Na dis person be di first person wey get Monkeypox wey don die for US and na only few people don die for di whole world.
Di authorities come point out say di person na adult but him get very weak immune system.
Di United States don get 18,100 cases for Monkeypox and new infections no dey too dey like before.
.
(AFP)