Home As e de hot Panic Dey as Monkeypox Don Enter Ebonyi State.

Panic Dey as Monkeypox Don Enter Ebonyi State.

510
2

Ebonyi State government, don confam their first case of Monkeypox yesterday, 15th August.

The Commissioner for Health, Dr. Daniel Umezurike, talk say di person wey carry am na man wey dey 32-years old wey come from Ugwulangwu in Ohaozara Local Council. The man dey stay for Abakaliki, but as e travel go Rivers State come back, e start to dey get fever, rash, sore throat, headache plus weakness of the bodi.

Dr. Umezurike – Oga Ebonyi State Commissioner for Health

Di Commissioner yan say dem first take sample to Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) lab and e come out positive say na Monkeypox before dem carry the man go isolation centre where dey collect treatment. The advise wey dey come from the Health Commissioner na make everybody dey calm but if you notice any kind case wey look like the virus, make you report am to the health office wey dey close to you. As di tori of dis monkey pox enter town, fear and jerking up of mind dey among di people of Ebonyi State, but di state government say dem dey on top di situation.

2 COMMENTS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.