Health experts don warn people wey get ulcer make dem no dey depend on milk to stop ulcer pain because na medicine wey doctor prescribe dem go need.
Di experts come tok say milk no suppose be first aid treatment for person wey dey get ulcer pain because milk just dey give temporary relief as e go just cover the top of di ulcer wound for sometime and once di body digest am finish, di pain go come back.
General Practitioner for di the Federal College of Education – Technical, Akoka, Lagos, Dr. Rotimi Adesanya come tok say milk dey only give sharp sharp relief wey no dey last and dat even low-fat Yorghurt fit dey better dan milk to di stomach when ulcer pain start, because Yorghurt get plenty good bacteria wey dey make di H. pylori bacteria harmless for di belle.
Adesanya still come tok say to drink milk or low-fat Yorghurt no be di best first aid treatment for ulcer because di first thing suppose be to take antacid wey go help to reduce di acid for belle and doctors dey always prescribe antacids for people wey get ulcer.
He still come tok say e dey important say anybody wey get ulcer dey get good hygiene like washing hands with soap and water, no dey eat food wey no pure because na one of di things wey dey help prevent am.
Specialist Registrar of Anaesthesia and Critical Care wey dey work for di Irrua Specialist Teaching Hospital, Edo State, Dr. Julian Ojebo, also tok say milk no be treatment for ulcer pain.
He tok say first dem go need to do test for di person wey dey get dị pain to know which kain ulcer di person get.
Dr. Julian come also add say when dem find out which kain ulcer e be and where e dey, dem go give di person wey get am drugs to reduce acid because na mostly production of acid wey dey cause di pain.
.
(Punch Healthwise)