Medical workers wey dey Ekiti State University Teaching Hospital (EKSUTH), Ado Ekiti, been do ‘We no go gree’ on Monday because say dem never pay dem allowi benefits.
Dem been come early momo on Monday lock up the office say people wey dey work there plus visitors no go enter di hospital.
Di work people wey dey under Joint Health Sector Union (JOHESU), been gather for di main gate of di hospital wey dey Adebayo come close everywhere and dem dey sing all the we-no-gree songs wey show say government no dey try for them.
Dem come tok say di blocking wey dem do na just warning as im last from 8 am to 12 noon. And as dem dey dat gate, nobody been enter or comot even doctors.
JOHESU Chairman, EKSUTH chapter, Omotola Farotimi come explain say di protest na to make government see say dem never pay dem salary arrears, cooperative deduction, leave allowi plus minimum wage wey dem never start to dey pay.
Mr Farotimi tok say e pain am well well say money wey management dey comot for cooperative never reach dem for 24 months and the whole money don reach like 1.6 billion naira.
Chief Medical Director for EKSUTH wey be Kayode Olabanji tok on di mata say hospital management been don meet with JOHESU last Thursday, tell dem say dem go do all their request.
Mr Olabanji still add say dem even stamp letter give JOHESU oga dem to hold body since August 19th, just to show dem say di management get dem for mind and dem go pay everything complete.