Di Nigeria Centre for Disease Control don confam 5 new case for Lassa Fever inside 2 states, Ondo and Edo.
NCDC been tok via día official website say this year, 2022 alone, dem don record 6,392 cases wey dem still dey suspect inside 25 states and 101 local government areas for di country.
For all di cases wey dem don confam, National public health institute record say 31 per cent na from Ondo, 26 per cent from Edo, and 13 per cent from Bauchi.
NCDC come add say inside week 33 wey be January 1, 2022, to August 21, 2022, na 168 people don die from di virus.