Naija don record 22 percent decrease for di Human Immunodeficiency Virus (HIV for short) infections from 2015 reach 2021 as di World Health Organisation tok am.
Di WHO also been tok say 90 percent of people wey dey live with HIV don get access to HIV treatment for di country.
WHO wey been tok for different tweets on Friday also add say 95 percent of people wey dey live with HIV know say dem get am for 2021 and also dem notice 22 percent decrease for infections from 2015 reach 2021.
WHO been tok far back in 2018 say Naija wey get di third highest HIV wahala been dey struggle with poor response because say di country dey get data wey no sure and dia service no dey cover everywhere.
Di organisation come point out say coverage wey di treatment get for 2021 don increase to 90 percent from 50 percent wia e been dey for 2015 when na only 61 percent of people for di country know día status.
Now, infection don reduce from 95,000 for 2015 to 74,000 for 2021.