Home As e de hot Facebook don catapult Anti-vaccine group.

Facebook don catapult Anti-vaccine group.

219
0

Meta wey be di mama company wey get Facebook talk say e don catapult one group for the app wey get plenty people but dey against vaccination because say dem dey spread fake news about COVID-19.

The tok tok person for Meta wey be Aaron Simpson talk say dem comot the account for Facebook and Instagram for Wednesday and dem do am after di group continue dey disobey dia rules.

Di group wey dem call The Children’s Health Defense talk say Meta dey collect im rights to talk.

CHD don dey talk say maybe Meta troway dem because dem been report the company to the law say dem no dey use better informate but na wetin Centre for Disease Control wey dey US tell dem about COVID-19 naim dem dey use and e make dem no dey gree make person talk free.

The group don dey drag Meta go lower court make dem settle for día.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.