Di Executive Director, Stop TB partnership Geneva, Dr. Lucica Ditiu, on Thursday, don badmouth di slow waka and poor conditions wey people wey dey do Tuberculosis work inside naija dey do.
Ditiu come tok dis one for goodwill message inside Lagos for dinner wey dem do with Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State and the Private Sector community on Domestic Resource Mobilisation to end TB for Naija.
Na Stop TB partnership Nigeria organise di event wey dem use as part of di High-level Mission on Domestic Resource Mobilisation to end TB for Naija.
Ditiu come tok say for naija TB never get attention wey e need at all because even tho say na disease wey get cure, e still dey kill people everyday and maybe na because say e never affect rich people.
Ditiu tok say some blockade wey di country dey face for TB eradication na money wey dem suppose use and better diagnostics wey dem suppose do through funding for di state governments.
Di executive director come breathe well say she dey happy say Gov. Sanwo-Olu understand say TB dey dangerous and him dey work to make sure say e stop.
Dr. Queen Ogbuji-Ladipo wey be Board Chair, Stop TB tok say TB dey kill more dan HIV/AIDS and dat naija dey in di 30 countries wey get serious TB problem for di world.
Ogbuji-Ladipo still come point out say Naija na di 6th country for di world and 2nd for Africa wey TB dey worry and e pain am because TB get cure and dem fit prevent am.
She still tok say she know say money no dey to comot TB for naija because na only 31 percent dey available for solve dis problem and 69 percent no come dey and because of this, e go dey very difficult to comot TB for naija.
She come beg say make everybody join hand so dem go fit use di resources wey dey to do something.
.
(NAN)