As a way to encourage communities wey dey jinja to make their primary health care work, TalkHealth9ja don carry examination couch, sphygmomanometer and stethoscope dash Amaogudu Health Post in Ugwulangwu, Ohaozara LGA of Ebonyi State.
We do dis one with di help of Open Society Initiative for West Africa (OSIWA) and di Ebonyi State MakeOurHospitalWork Campaign. Na di Ugwulangwu Team Lead of di Campaign, Daniel Chinagorom bin do di presentation to the health committee members on our behalf.
Di people of Amaogudu Ugwulangwu decided to start dis health post after Talkhealth9ja and Ebonyi MakeOurHospitalWork teams open dem eyes in November 2021 say dem get power to help themselves on top primary health care mata.