Home As e de hot Ebola virus don get 2 treatments – WHO

Ebola virus don get 2 treatments – WHO

226
0

Di World Health Organisation don tok on Friday say 2 treatments wey dem don get before just surprise dem come reduce the death for Ebola and make everybody start to dey take the treatment.

Dis na di first guideline wey UN health agency dey write wey people go fit use fight Ebola and dey tok say make people dey use di two monoclonal antibodies, mAb114, wey dem also dey call Ansuvimab or Ebanga, and REGN-EB3, or Inmazeb.

Janet Diaz wey be di lead for the clinical management unit inside the WHO’s Health Emergencies programme tok say studies don show say di 2 treatments dey reduce death wey Ebola dey cause and depend on how dem use am, e dey save atleast 230 to 400 people for every 1,000 people wey dey infected.

For di guidelines dem release, WHO tok say make dem no use di other treatments dem been dey give before wey include monoclonal antibody ZMapp and antiviral drug remdesivir.

Ebola Virus

Ebola na very serious virus wey dey kpai most people wey im affect and e dey quick affect people. Dem been first notice am for central Africa in 1976 and dem come name am after one river for the Democratic Republic of Congo wey been dey answer Zaire.

Di time wey e been show im full power well well for West Africa na between 2013 and 2016 when e kpai more than 11,300 people. E show e power plenty times for DRC but di worst na when e kill 2,280 people for 2020.

Once person get di disease, e no dey tey before e kill unless say dem discover am sharp sharp come treat am and na things like high fever, vomiting and bleeding be di signs wey e dey show. Dis virus dey spread through fluid wey dey body.

Di WHO come tok say make dem no delay give anybody wey carry dis virus di mAb114 and REGN-EB3 and dem fit use am for anybody including older people, pregnant and breastfeeding women, children, and newborn pikin dem.

.

AFP

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.