Di Nigeria Association of Resident Doctors don reveal say 6 out of 10 doctors wey dey di country dey plan to japa.
Report wey dey, dey show say na only 12,297 resident doctors for both the Federal and state tertiary health institutions dey for di country.
Di NARD President, Dr. Dare Ishaya, been tok say now dem get only 9,297 resident doctors for di FTHI and about 2,000 to 3,000 resident doctors for di STHI.
Di Nigerian Medical Association for dia own side come tok say brain drain for di country go worse if more doctors japa.
Di NMA President, Dr. Uche Ojinmah, open up say for analysis wey dem do, naija wey get 200 million people get only 20,000 to 25,000 doctors and e dey show say na 1 doctor to 4,000 or 5,000 patients but World Health Organisation been tok say na 1 doctor to 600 patients.