Home As e de hot Dirty Boxers dey cause body odour, infection – Dermatologist

Dirty Boxers dey cause body odour, infection – Dermatologist

440
0

Consultant Dermatologist wey dey di University of Nigeria Teaching Hospital, Enugu, Dr. Uche Ojinmah, don warn men dem wey dey wear one boxer for many days and dey no wash am say dirty boxers dey cause body odour and infection.

Di skin doctor tok say e dey very wrong for man to dey wear one boxer or singlet for 2 days and e no go wash am.

He tok say nothing dey like natural body odour and body odour dey only come wen person no dey dey clean or e dey use some type of bleaching cream.

Di doc come tell men make dem get at least seven boxers and seven singlets and make dem dey keep their clothes clean.

Dr. Ojinmah come tok say to treat body odour people suppose dey baff 2 times a day with enough water and people wey don get odour already go need wash dia armpits and private part well well as dem dey baff.

He also add say make men dey use cream. Dem fit dey use petroleum jelly like vaseline and make dem also buy deodorant, moisturisers, perfume and sunscreen because e go help.

.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.