New report wey we just dey gather from the Nigeria’s National Immunisation Coverage Survey (NICS), dey show say the number of pikin dem wey dey marry before 18 years for we country don reduce from 44 percent wey e been dey for 2016 to 30 percent for 2021.
Dem been show this for the opening of the 2021 Multiple Indicator Cluster Survey (MICS) plus the NICS report wey National Bureau of Statistics dey coordinate in collabo with UNICEF. This survey still show say death in small pikin been reduce by 1 in 8 children wey dey die before they reach 5 years old (2016 report) to 1 in 10 children (2021).
No be there e stop ọ, the report still show say mothers don dey embrace exclusive breastfeeding more and dem dey register pikin wey dem born more because exclusive breastfeeding jump from 24 percent to 34 percent and almost 60 percent of pikin for Naija dem don dey registered for the right authorities.
As the Vice Presido wey suppose come the event no dey, him represent wey be Minister for Finance, Budget and Planning, Zainab Ahmed, come talk say government go use this report to make sure say them improve vaccination efforts make e cover every citizen wey need am.
She also talk say dem go make sure say economy stand gidigba so development go dey for every level.