Today, oga Presido Muhammadu Buhari don give carry-go to di 16-member Naija End Malaria Council (NEMC) for inside State House, Abuja.
The Presido point out say if the council succeed, e go be win win for us because e go helep save lives, come improve health and e go still save the country plenty money, N687 billion for 2022 and N2 trillion by 2030, wey dem go use do other things for the citizens. Na oga Dangote be di Chairmo.
The Presido still talk say the End Malaria Council go make way wey dem go use collect free money dem go still use make sure say Malaria japa finally because according to wetin World Health Organisation (WHO) talk for their 2021 report, 27 out of every 100 people wey dey suffer Malaria for obodo world dey Naija and out of every 100 people wey malaria kill worldwide, 32 na Naija dem dey.
For the opening ceremony, the Minister of Health, Osagie Ehanire, and the Minister of State for Health, Joseph Nkama, dey present and they talk say since 2010, Malaria cases for Nigeria don dey go down from 42 percent for 2010, to 27 percent for 2015 to 23 percent for 2018 and this na because of the work wey National Malaria Strategic Plan (NMSP) dey do.But dem also add say money na very big problem and e dey slow their work down and the country go need N1.89 trillion to reduce malaria and the palava wey e dey cause by 2025.