Nutrition Manager wey dey work with UN Children’s Fund, Kano Field Office, Elhaji Diop, don talk say breastfeeding dey reduce risk of breast cancer.
Diop tok dis one for the opening of di campaign dem call ‘Stronger with Breast Milk Only” Campaign wey dey do for inside Mashi Local Government Area of Katsina State as we dey 2022 World Breastfeeding Week.
He also tok say e dey reduce risk of ovarian cancer, postpartum depression, hypertension, cardiovascular disease, plus type-2 diabetes mellitus.
Diop still add say pikin dem wey take breast milk no dey too get atopic dermatitis and gastroenteritis and their brain dey sharp well well. And on top of Dat, breast feeding dey help for food security provided food security and na big tool wey dem fit use fight poverty and disease.
Him come still tok say e dey helep di state too as e dey reduce money wey dem dey take run Healthcare, e dey bring up educate for pikin dem and as the state dey get plenty number of children wey dey die, e go helep save dem.
Diop still come give dem message say UNICEF dey beg government and ogas dem for health sector make dem put hand together support breastfeeding.
(NAN)