Di Bauchi State Government don start im 2022 Seasonal Malaria Chemoprevention campaign for all the 20 local government area for pikin dem wey dey 3 to 59 months old on Monday for inside Dass LGA, Bauchi.
Dr. Mohammed Sani wey be di Executive Chairman of Bauchi State Agency for the Control of HIV/AIDS, Tuberculosis, Leprosy and Malaria, tok say di exercise go be house to house something and e go run from July reach October as dat na when Malaria dey high for their state.
Sani still tok say dem been start dis SMC for 10 LGAs for 2020 but dem don move to 20 LGAs because e dey successful.
He also tok say di state get other ways wey dem go take fight Malaria like to share wetin dem call Intermittent Preventive Therapy for pregnant women and also Long lasting insecticidal nets.
Di Emir of Dass, Alhaji Usman Bilyaminu, also beg mama and papa dem to bring out their pikin for this exercise so we go go well.
.
(NAN)