Di Bauchi State Government don begin five-day rotavirus vaccination exercise so dey go fight di disease for dia state.
Dr. Rilwanu Mohammed wey be Executive Chairman, Bauchi State Primary Healthcare Agency, tok dis one for di carry-go ceremony of di vaccination exercise inside Bauch on Thursday. Rotavirus na virus wey dey cause inflammation for di stomach and intestines.
E fit cause severe diarrhea, vomiting, fever, belly pain, and dehydration in infants, small pikin dem, and even adults. E dey very contagious too.
The Rotavirus vaccine na to protect against di infections.
Mohammed tok say di agency don share 200,000 doses of dis vaccine to primary health facilities for all di 20 local government areas wey dey di state.
He tok say di state government don add Rotavirus Vaccine inside di normal routine immunisation so dem go fit improve quality of mama and pikin health matter.
He still tok say di Federal Government don set apart 900,000 doses of the vaccine for Bauchi State but na only 200,000 doses dem don collect for now.
Mohammed come thank di National Primary Healthcare Development Agency and development partners for di support wey dem give primary Healthcare services.
.
(NAN)