Home As e de hot Africa too dey depend on top health goods wey dem import –...

Africa too dey depend on top health goods wey dem import – Minister

206
0

The Minister for Health, Dr. Osagie Ehanire don badmouth di way wey Africa dey depend on health goods wey dem dey import.

Dr. Ehanire been tok dis one for di 72nd session of the World Health Organisation Regional Committee for Africa wey happen for Lome, Togo.

He tok say Africa suppose get more places wey dey manufacture health goods.

Deputy Director/Head, Media and Publicity of the Federal Ministry of Health, Ahmadu Chindaya tok say e no dey easy for di sub-region because say dem dey depend on top health goods wey dem dey import.

He come tok say Naija na one of di countries wey still dey recover from all di palava wey COVID-19 bring.

He still add say Naija dey try to make sure say dem give strength to public health security so di country go dey ready incase any big health palava come just like Universal Health Coverage set.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.