For inside TalkHealth9ja Radio show today on Unity 101.5 FM Abakaliki, di people of Amorie Ozizza talk say dem need help to compete their health centre. Di Ozizza Health Centre wey dey their village na their first inside di whole Ozizza community and they don get quit notice to komot from di rented house dem dey before. They don begin dey build new one but need help to complete am.

They also say na only 2 skilled health workers dem get instead of 18 and wan make government employ more. Callers for di show hail dem say dem dey try with their efforts to make their health centre kpoikally kpoi kpoi.
Di link to the show dey here.