The Naija Centre for Disease Control don talk say people wey don kpai from Lassa fever for inside 2022 don reach 165.
Dem talk this one inside new report wey dem drop for their website. E talk say people wey dem still dey test for the virus don pass number of people wey dem been dey test last year.
The report come show say from January to August 7, 2022, dem don confam 880 cases and dem dey suspect say 6126 other people carry the infection.