Di World Health Organisation don reveal for dia official website say people dey born almost 1000 pikin wey get sickle cell everyday for Africa and dat more dan half of these pikin dem go die before dey reach 5 years because of infection or serious anemia.
WHO tok say sickle cell na One of di most common disease wey dey affect pikin dem for areas wey no dey get serious attention and 66 percent of di 120million people wey get di disease for di world dey live inside Africa.
Di agency come point out say public health facilities wey dey Africa no get wetin dey go use make sure say dis disease no happen and dey no even get wetin dem go use find out early if e don happen or to care for di person.
African health ministers come table dis mata, join hands say make dem do campaign so people go know about dis disease and wetin dem go do to prevent am and care for people wey get am.
Dem launch dis campaign for Tuesday when dem do di Seventy-second World Health Organisation Regional Committee for Africa.
WHO still add say na because people no dey put eye for di disease dey make am dey grow anyhow because for 2019 alone, Africa been record 38,403 deaths from sickle cell disease and dem get 26 per cent increase from the year 2000.
Plenty supporter dey for di campaign wey be di World Bank, the United States Department of Human and Health Services, Novartis Foundation, Global Blood Therapeutics, and Sickle in Africa.