Home As e de hot 1 million people don kpai from Covid for 2022! – WHO

1 million people don kpai from Covid for 2022! – WHO

191
0

Di World Health Organisation tok on Thursday say 1 million people don kpai from covid-19 for 2022 and dat na very heartbreaking mata so more people go need to get vaccines to fight this pandemic.

Oga DG for WHO, Dr. Tedros Ghebreyesus tok say people dey do like say we dey learn to live with di disease but 1 million people don kpai dis year alone.

He come beg all di governments make dem apply pressure for anything wey dem dey do to make sure say all di people wey dey work for health, old people and plenty people wey get more risky chance take dis vaccine so at least 70 percent of people wey dey for di world go dey safe.

Di WHO oga tok say he dey happy say some countries wey been no vaccinate much people don dey gather ground.

He tok say even tho say progress dey on top vaccination of di high-priority groups, dem need to do more because one-third of the people for di world never take di vaccine.

Ghebreyesus tok say people wey never collect dis vaccine include two-thirds of people wey dey work for health and three-quarters of older people wey dey live for poor countries.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.