Na today World Glaucoma Week start for obodo world and na till 12th March wey bodimata people go dey create serious awareness about di disease. Glaucoma na serious sickness wey dey cause permanent blindness.
Dr. Sewuesse Bitto wey be specialist for di treatment of eye disease talk say Glaucoma dey preventable. But say e no get cure and di treatment na for life. She advised Naija people to take advantage of di World Glaucoma Week go torchlight them eyes free of charge inside different hospitals for we kontri.
Dr. Bitto dey work as a sabinus for eyes matter inside Federal Medical Centre (FMC) Abuja. She talk say na early detection better pass because glaucoma no dey look uche face. Abeg no miss our TV show on Tuesday 8th March as she go talk other plenty things on di causes and prevent of Glaucoma.